Home news Beverly Afaglo dead: Popular Ghanaian actress die four days to her birthday...

Beverly Afaglo dead: Popular Ghanaian actress die four days to her birthday at age 42 – BBC News Pidgin

15
0
Beverly Afaglo dead: Popular Ghanaian actress die four days to her birthday at age 42 – BBC News Pidgin

Wia dis foto come from, @cmdamusikbird_/Instagram

Published

Read am in 5 mins

Tributes begin to pour in for popular Ghanaian actress and TV personality Beverly Afaglo wey di at di age of 42.

Her husband Eugene Baah wey be musician and popular as ‘choirmaster’ announce di death on top im Instagram page on Sunday morning.

Choirmaster wey formerly belong to Ghanaian music group – ‘Praye’ pay tribute to im wife.

“My heart dey shattered beyond words ova di death of my beloved wife Beverly Afaglo.”

Choirmaster add say “dis go be four days to your birthday bifor, but God wan celebrate wit you dat be why im call you.”

Di musician inside im tribute on top im verified Instagram page tok say “you be my strength, my happiness and di reason why my life bin feel complete”.

“I go cherish evri moment I bin spend wit you forever, I dey hear your voice now, wey dey cheer me up as always my number one fan,” Choirmaster add.

“I promise say I go take care of evritin we bin plan and start, until my last breath, you go dey inside my heart, sleep well my babe.”

Im neva announce di cause of death but industry pipo say she bin don sick for sometime.

Inside one old interview wit local media Joynews for 31, August 2019, Beverly confam say her papa and sister bin die of cancer.

“I fit confam say cancer bin dey our family. We don dey scared sake of my papa and sister all die from cancer. Make pipo take cancer seriously from early checks to treatment, make pipo take am seriously.”

Afta dis post, social media don dey buzz wit messages and tributes for di 42-year-old actress and entrepreneur.

Tributes from entertainment industry and odas

While most people are shocked about the news being described as a rumor, some wonder if the musician’s account that announced the death was hacked.

But many odas say dem wonder why di actress no dey active for social media for months.

Some industry pipo meanwhile begin dey pour tributes for di actress wey star inside movies like ‘Babylon’, ‘The Game’ and ‘The Agency’.

Former Ghana Film Authority CEO Juliet Asante write on top social media say, “I just speak wit your brother, we go miss you Beverly Afaglo-Baah. You don leave us so soon, but you dey beta place – travel well. Thank you for say you share yoursef wit us magnificently.”

Silverbird Cinema also share dia shock about di death of di actress.

“We dey sad to hear of di death of talented Beverly Afaglo. Di creative community don lose true gem.”

Silverbird Ghana add say “our sincerest condolence and prayers dey wit her family, loved ones and colleagues for dis difficult time, may her soul find eternal rest”.

Socialite and actress Rosemond Brown aka Akuapem Poloo write say “I neva sabi why good and real pipo neva dey stay long to enjoy dia good deeds, dis one dey hurt well well.”

Media personality Stacy Amoateng say she shock about di news.

“I dey speechless and upset. Your birthday bin dey come bifor. You don fight, soldier on and rest for power my dear friend.”

Actor Harold Amenyah write “dis one dey hurt me too much Beverly.”

Who be Beverly Afaglo

Beverly be actress and entrepreneur wey bin dey di entertainment industry for 2005, ova 20 years.

She bin act ova fifty movies.

Beverly be trained beauty therapist wey also go journalism school to become presenter.

Di actress bin present shows for TV3 and Metro TV di time she also bin dey act movies.

She bin get several businesses, but di most popular one be her shawarma business wey get branches for many parts of Accra.

Her industry friends and oda celebrities bin dey patronise her shawarma business well well wey dem continue to open branches for oda parts of di city.

Beverly bin marry her musician husband Choirmaster for April 2012 afta dem date for four years.

For August 2021, di mama of two lose her house to fire.

Some celebrities like actress Yvonne Nelson and odas begin online fundraiser to help her rebuild at dat time.

But di late actress ask pipo to stop donating afta some fans drag her online.

“Di GoFundMe and oda donations don end, I tank all my celebrity friends wey support dis move, I dey sorry say sake of me, pipo insult and drag you pipo. Make you forgive me.”

Four years afta dat fire accident for her house, di actress bin build new apartment complex wey she launch am for 22 July 2025.

She announce say she bin dey rent di apartment block wey get plenti rooms for long and short stay.

For August 2025, she cut her hair wey she bin dey bald wen she appear for public to promote her movie – di one she bin produce by hersef.